Sisi Eko

Me abi Sisi o,
I no get time for nonsense
As you see me so,
I sabi wetin I want
I no want small boy
I no want small house
I no want small motor
Every thing must big well well
So that as I dey pass for street
Every body go dey shout "Alaye!"
If you no know me, you go know me by force
Even if my leg touch sand sand, I go still dey waka
The inyanga wey dey my body too much
See as the woman dem dey jealous me
As for me, I no wan know
Me abi Sisi Eko
I sabi wetin I want.

Send to a friend!

Back to the Poet's Corner

Back to my Homepage